Over 150 deaths recorded in Niger state deadly floods as more pipo still dey miss

Foto of how flood carry houses for Niger state, north central Nigeria

Wia dis foto come from, Makail Musa

Ova one hundred and fifty pipo don die sake of flooding for Niger State, northcentral Nigeria, authorities tok.

Dr Ibrahim Husain wey be di Acting Director General of di Niger State Emergency Management Agency (Nsema) confam di latest number of casualties to our tori pesin. E also give breakdown of di damages wey di flash floods cause for Mokwa Local Goment Area.

Di flood wey happun on Wednesday night for Mokwa local goment area of di state sake of heavy rainfall destroy shops, houses, and farms.

For statement wey Nsema bin release on Thursday, di agency say di deadly flood disaster wey happun scata two communities wey be Tiffin maza and Anguwan hausawa for Mokwa town, Mokwa local goment area.

But di latest records as at Saturday 31 May, 2025, Nsema say na 151 deadibody dem don recover. 11 pipo wound and over 3,000 pipo dey displaced.

Im add say di households wey dey affected na ova 500 and 265 houses na im dey affected.

Di flood destroy two roads and two bridges.

'Since dem born me I neva see dis kain flood bifor' - Mokwa District head

District head of Mokwa, Muhammad Aliyu Shaba, say since dem born am im neva see dat kain flood bifor.

"We just wake up for morning and we see flood wey don scata all my community. We don record more dan 100 deaths and ova 800 pipo still dey miss.

In fact we still dey find deadibody dem from hia reach River Niger. Na why I wake up early morning to assist di rescue and search team."

Oga Aliyu add say di road dey completely blocked and we get bye- wey goment neva work finish. Like say dat road dey all di chop-off for Mokwa road for no happun.

Di road wey we dey manage now sef no dey good, we dey beg goment to help us wit di road so dat long vehicles and oda vehicles fit .

Di vice chairman of Mokwa local goment area, Musa Aliyu describe di flood as spiritual water.

Im say for dia Nupe tribe, dem dey call dis kain flood 'Mainyara' (spiritual water) wey dey come occasionally.

"I no fit describe am for English but na spiritual water wey dey come seasonally, as e come now e go reach anoda 20 years bifor e go come again, na wetin we see yesterday (Wednesday) if not plenti water no dey around us wey fit cause flood."

Im say di pipo for communities for Mokwa need goment intervention sharp-sharp.

"We dey call on goment to come help us becos our pipo dey suffer, we need immediate intervention, if not we dey inside big problem inside Mokwa for now. Make goment help us sharp- sharp."

Di vice chairman say hundreds of pipo still dey miss and many pipo properties dey destroyed.

Anoda eyewitness, Abubakar Isa, say di issue don big dem.

"Dem born me for dis village and I grow up for hia, I neva see dis kain rain and flood bifor.

We wake up between 7 to 8 am for morning, some pipo don already cross di bridge to go anoda place, some pipo don already dey go farm.

We just stand begin see flood water start to enta our houses, many pipo don die, many properties don spoil, pipo wey store dia farm produce for store don lose am too."

Im say dem need serious help becos some pipo no get even single cloth to wear and some pipo no know how dem and dia familiy wan take chop or how dem go survive

Kasemu Mohammed chook mouth for di flood mata. Im say "di water come from Mashegu local goment area, Zuburma and Ibi sake of di heavy rain wey bin fall. Di water from dia find im way into Mokwa town".

Nsema tok for statement on Thursday say "heavy rain fall wit veri high intensity wey bin last for many hours. Di flood water wey bin kontinu to rise swallow houses".

Di agency say di flood carry ova 50 residential houses wit di pipo wey dey live inside.

Nsema add say dem do collabo wit Mokwa local goment authority, local divers and veri brave volunteers wey bin conduct search and rescue operation to rescue survivors and recova deadibody dem.

According to di statement, dem bin rescue three pipo, one woman and her two pikin dem wey dey receive treatment for wounds and shock for Mokwa general hospital.

Na 21 deadibody dem bin say dem recova from di incident earlier on, latest tori be say na ova 100 deadibody dem don see.

Pipo dey  inside flood water while some climb ontop roof

Wia dis foto come from, Makail Musa

Wetin we call dis foto, Pipo dey inside flood water while some climb ontop roof

Di flood scata di Mokwa road wey dey link dem to di south and e bin cause serious traffic.

Tori be say dem still dey find plenti pipo wey dey miss and goment agencies dey help to search for di pipo. Rescue operation still dey go on.

Flooding for Nigeria

Devasting floods na common tin for Nigeria and parts of West Africa. For September 2024 floods bin hit Borno State northern Nigeria wia Govnor Babagana Zulum bin tok say di victims of Maiduguri flood no fit be less dan two million.

According to di govnor, thousands of pipo wey di flood bin pursue from dia house bin stay for four different camps.

Many pipo bin stay for roof witout food for days. Govnor Zulum goment bin assist as e bin share food.

Some of di victims bin tink say dem go die wit dia children sake od di flood but rescue later come for dem.

Apart from heavy rainfall, one of di causes of flood na dam failure.

Nigeria goment bin list states wey go experience heavy rains and floods for 2025. Di year neva go anywia and di flood kasala don already start.