Senator Natasha Akpoti-Uduaghan tok her next line of action afta Nigerian goment sue am

Senator Natasha Akpoti-Uduaghan speaking

Wia dis foto come from, Natasha H Akpoti

Di suspended lawmaker wey dey represent Kogi Central Senatorial District for di red chamber, Natasha Akpoti-Uduaghan, say she dey tok wit her lawyers to get copies of di lawsuit wey di federal goment file against am.

Dis dey come as di office of di Attorney General of di Federation sama lawsuit ontop Senator Akpoti-Uduaghan.

Dis lawsuit na sake of allegations wey Mrs Akpoti-Uduaghan bin make for one TV interview on April 3, 2025, wia she tok say Senate President Godswill Akpabio and former govnor of Kogi State Yahaya Bello, bin dey plan to kpai her.

"I dey actually shocked. My first reaction wen I read am na out of shock, becos dem neva serve me [with papers] till now. I gatz read am on di news, and I dey actually shocked say such investigation bin dey go on," di lawmaker tell BBC.

Senator Akpoti-Uduaghan say na she go to di police and write petitions of "threat to my life, accusing Yahaya Bello and di Senate president".

"Na me write di petitions, and e dey worrisome say dem no attend to my petitions. Instead, na di Senate president and ex-govnor Yahaya Bello counter petition, wey tok say I defame dem na im dem dey attend to. You understand di twist");